My Poetry
E GO BE One day, One day, as I go dey waka for road I go see say my street be like abroad And for night wen I reach bustop enter Ojuelegba bus I no go too fear say dem fit kidnap us enter koro. I been sidon the oda day ask myself one question "Wetin go make me finish school come go do coper shun"? Shey na for dis very country wey everything don dabaru? Wey people wey no sabi talk better say na their turn to rule? As e be so, everybody don taya, no cap But I sha get hope for mind say good thing fit still happen As dem don talk say light dey at the end of tunnel wey we go use see After all, we all don too waka waka and suffer, but e go be. I don reason am say I go fit use dis hope hold body Unto say some kain things been don already occur wey bloody Make I just dey watch dey pray say time go reach Make I for fit japa, come look sapa for face Tell am say, "O boy! E go be, see you never" N.B: This is my first pidgin poem which has been published in the longest surviving...